VIRAL

Lady Curses Man At The Riverside For Lying That He Never Promised Her Money (Video)

A lady has sparked reactions on social media after she visited a river to lay curses on a particular “Emma” who offended her.

At the riverside, the aggrieved lady brought out two eggs which she smashed close to the river, while stating that the man’s life will scatter the same way she scattered the egg.

Speaking on what he did to her, the lady said he lied that he hasn’t seen her for the past 17 years, and also lied that he never promised to give her money.

In her words;

“Emma don buy market wey e no go fit pay o. Emma see your name for my hand o. This one na your name. See my name. These two eggs wey dey my hand, I go scatter am. The battle line has just been drawn. As I take scatter this egg, if I lie against you, make my life scatter. But if I no lie against you, as I take scatter this egg, na so your life go scatter. And no native doctor go fit solve your problem. No prophet go help you. Anywhere you go, them go tell you say na wetin you do your cousin dey worry you.

Emma you say you no see me for the past 17 years say I lie, say na person pay me make I scam you. Emma you no go know peace for your life. I lay curse upon you with this pain you put me through.”

For those of una wey dey lie say na lie wey I lie, as I dey comment say na lie I lie, say I just wan spoil em name, if na true, make the curse work against me. But if no be true and una dey curse me and my children and my generation, as from today henceforth, una no go know peace. If una drink water, e go become problem. If una chop food wey salt dey, e go be problem.

Emma say me and am no travel together. Emma say e no promise me money. The thing wey you commot for my body dey worry me o. I dey make this video make the whole world see am o. Emma see your name and my name for my hand o. I wan scatter this egg for this water. You no go know peace.”

Watch video below;

Leave a Comment